Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 37:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Na my papa dem distroy Gozan, Haran and Rezef town and dem kill Eden pipol for Telassar and no god fit save dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 37:12
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Terah kon karry en pikin Abram, en grand-pikin Lot and en pikin wife Sarai, dey follow body go Ur for Kaldea, so dat dem go-go Kanaan. Wen dem rish Haran, dem kon stay for der.


Di total life wey Terah live na two hundred and five years, den e kon die for Haran.


Wen Abram enter Egypt, Egypt pipol si as di woman fine well-well.


God make Eden Gardin for di east kon put di man wey E kreate for der.


Jakob kon ask am, “My brodas, where una from kom?” Dem ansa, “Na from Haran.”


For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.


Assyria king kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) for Medes town.


Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem?


“Make una nor let Hezekaya deceive una sey God go save una. E get any god wey fit save en pipol from Assyria king?


Where Hamat and Arpad gods dey naw? Where Sefarvaim gods dey sef? E get anybody wey save Samaria?


Wish time any kountry god don fit save en pipol from awa king? So, wetin make una tink sey una God go fit save Jerusalem?”


Where di king dem wey dey for Hamat, Arpad, Sefarvaim, Hena and Ivvah town?”


Haran, Kanneh and Eden town; di sojas for Sheba, Asshur and Kilmad town; all of dem dey buy and sell with una.


Yu dey stay for Eden, God gardin. Dem kover yu with fine stones like rubis, diamonds, topaz, beryl, karnelian, jasper, safayas, emeralds and turkwoise. Na gold dem take make evritin about yu and dem make all dis tins for yu for di day wey God kreate yu.


I go skata Damaskus town gate; I go remove di ruler from Aven Valley kon kill di pesin wey whole di royal rod for Bet-Eden. Dem go katch Aram pipol kon karry dem go Kir land as prisona.” Dis na wetin God tok.


Stefen ansa, “My brodas and fada, make una listin to wetin I won tok so. Na wen Abraham, awa grand-grand papa dey for Mesopotamia, before e go stay for Haran, naim God wey get pawa, appear to am


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ