15 Make una nor let am force una trust God. Abi una tink sey God go save una, so dat Assyria sojas nor go kapture una town?
Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?
“Make una nor let Hezekaya deceive una sey God go save una. E get any god wey fit save en pipol from Assyria king?
Wish time any kountry god don fit save en pipol from awa king? So, wetin make una tink sey una God go fit save Jerusalem?”
Di Assyria ofisas still sey, “May bi una go tell mi sey, ‘Wi trust di Oga awa God.’ But nor bi en Hezekaya curse? Hezekaya nor skata all en shrine and altars kon sey evribody for Judah and Jerusalem go woship for only one altar for Zion?
for Judah sey, “Di God wey yu dey trust don tell yu sey I nor go fit kill yu, but make yu nor let dat one deceive yu.
Yu don hear wetin Assyria king dey do any kountry wey e won distroy. Yu tink sey yu fit eskape from am?
Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ”