14 E dey warn una sey make una nor let Hezekaya deceive una, bikos Hezekaya nor go fit save una.
Na who yu dey trobol and curse like dis? Na who yu dey shaut for and look with bad eye? Na di Holy One for Israel?
King Hezekaya tell una sey, ‘Di Oga wey bi awa God go save us from Assyria king pawa.’ But e dey deceive una and honga for food and wota go kill una.
Make una nor let am force una trust God. Abi una tink sey God go save una, so dat Assyria sojas nor go kapture una town?
As e rish der, e kon shaut, “Daniel, God wey nor dey die savant! Di God wey yu dey serve fit save yu?”
E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.