Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 35:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Dem go dey happy, dey sing and shaut with joy till dem rish Jerusalem. Dem go dey happy forever and dem go dey free from sorrow and pain.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 35:10
31 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make pipol wey God don save, tok about am. Make dem tell odas sey E don save dem from dia enemies.


Wi bigin laf kon dey sing for joy. So di oda nashons kon sey, “Di Oga God don do good tin for dis pipol o-o.”


Pipol wey sofa plant dia seed, go harvest wetin dem plant with happiness.


E go from Zion kon save Israel pipol! So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.


My God, make Yu give mi my joy back and make my bones wey Yu break, strong again.


Yu dey provide for dem as dem dey travel go di temple and each of dem dey kom meet Yu for Zion.


Bikos God dey holy, E go save Jerusalem and anybody wey turn from sin kom meet am.


God wey get pawa go distroy and swallow deat forever! Doz wey dey kry, God go klean dia eyes and E go remove di disgrace wey en pipol don sofa for dis world. God, wey dey lead heaven sojas, don tok.


Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help.


Di desert go sing and shaut bikos e dey happy; e go fine like Lebanon mountins. Di soil go dey good like Sharon and Karmel farms. Evribody go si God glory, en greatness and pawa.


God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.


Una go blow dem and breeze go skata and karry dem go. Una go dey happy, bikos na mi bi una God, den una go praiz mi wey bi Israel God wey dey holy.


Una days of pains don end. Mi wey bi God go bi una lite forever and e go last pass di sun and moon.


Una shame and disgrace don end. Una go stay for una own land and una propaty go bi times two, den una joy go last forever.


But make una dey happy forever, bikos of wetin I go kreate. Di new Jerusalem wey I go make, na only joy go full am and en pipol go dey happy.


Joy go full my heart, bikos of Jerusalem and en pipol. Pipol nor go kry or feel pain for der again.


Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.


Di pipol wey dey stay der go sing, praiz and dem go shaut for joy. My blessing go make dem many well-well and e go bring honor for dem.


Una go hear am kon shaut with happiness, with joy and belle go sweet una wen una dey do marriage. Una go hear pipol dey sing as dem dey kom tank mi with dia ofrin. Dem go sey, ‘Make wi tank God wey dey mighty, bikos E good well-well and en love dey forever.’ I go make dis land prosper as e bi before. Mi, wey bi God, don tok.”


just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”


Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.


E die so dat evribody go dey free. Na dis message God go give di world, wen di time don rish.


Make una keep unasef inside God love as una dey wait for awa Oga God Jesus Christ, wey go bring life wey nor go end.


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


E go klean evry tears from dia eye and deat nor go dey again. To dey mourn, kry and pain nor go dey again, bikos di tins wey dey before, don vanish.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ