Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 34:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Edom rivers go turn black like shako and di land go turn to sulfur. Di whole kountry go black like shako too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 34:9
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E look face Sodom and Gomorrah side and all di valley, but na only smoke e si wey dey kom out from der.


Fire go burn wiked pipol house. Yes fire with sulfur don skata dia house rish groun?


E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.


Dem don already prepare di place where dem go beri Israel enemies put; dem don make am deep and wide for dia king. Dem don gada di firewood and God breath wey bi like fire and sulfur, go kom like river wey dey flow kon distroy en enemies.


I don swear sey Bozrah town go turn desert wey go dey make pipol fear; pipol go laf and use dem as curse. I go skata all di village wey dey around dem forever. Mi, wey bi God, don tok.”


but di day wen Lot komot from Sodom, fire and sulfur fall like rain from heaven kon kill all of dem.


Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy.


Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ