Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 34:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 God don plan di day wey E go revensh Edom pipol for all di bad tins wey dem do en pipol, Israel.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 34:8
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My Oga wey dey fight for pipol. Di God wey dey take revensh, make Yu show us yor glory!


So make una kry with pain, bikos di day wen God go judge una don near; di day wen God wey get pawa won take distroy evritin.


Si, di day wey God go judge us dey kom; na dat day E won take show en vexnashon, den di eart go turn to desert and E go distroy evribody wey dey sin.


bikos God dey kom from where E dey stay for heaven kon ponish pipol bikos of dia sins. Di eart go show all di innocent pipol blood wey dem share on-top am and e nor go ever forget di innocent pipol wey dem kill.


Make una tell evribody wey nor get hope sey, “Make yu dey strong, nor fear at-all! God dey kom save yu and E go ponish yor enemies.”


Pipol go si yor nakednes and shame go katch yu well-well, bikos I go revensh and I nor go sorry for yu.”


I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”


E send mi kom tell pipol sey di time for God to save en pipol and defeat dia enemies, don rish! Yes, E go konfort doz wey dey mourn.


I just feel sey di time to save my pipol don rish and na di rite time to ponish dia enemies bi dis.


Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.


Di time to ponish Israel don rish; di time wey pipol go get wetin dem deserve. Dat time, Israel pipol go know wen e happen! Una sey, ‘Dis profet na fool. Dis man wey feel sey e know well-well, dey kraze!’ Una hate mi well-well, bikos una sin too many.


Tyre, Sidon and Filistia pipol, wetin una dey do mi? Una dey try to pay mi back for wetin I do? If na so, den I go kwik-kwik attack una!


Make una listin to wetin God dey tok: “Make una stand up kon tok wetin I do una. Make di mountins and hills bi witness to wetin una dey tok.


una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem?


But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.


I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”


Di smoke from dis sofa go dey go up forever and ever. Doz wey dey woship di beast, en image and doz wey kollect di mark, nor go rest for day or nite.”


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ