Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 34:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 E go dey burn both for day and nite and smoke go dey kom out from am forever. Nobody go ever fit stay or travel pass di land from one generashon go rish anoda.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 34:10
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just as dem dey distroy grass with fire, na so dem go distroy men wey get pawa bikos of di evil wey dem do and nobody go fit stop di distroshon.


Nobody go stay der again. No human being go ever stay der again and nobody wey get animals go karry en animal go chop grass for der again.


Si, awa Oga God dey ready to skata di world kon turn am to where dem dey trow dirty put. E go shake di world kon skata evribody wey dey stay inside.


Na God go divide di land give dem and E go give evribody di one wey rish am. Dem go stay for di land from one generashon go rish anoda one.


All doz wey bin fight mi, dem go si dia dead body for road. Di worms wey chop dem nor go ever die and dem nor go ever kwensh di fire wey go burn dem. Dia dead body nor go dey good for human being to si.”


Na di same tin wey happen to Sodom and Gomorrah, go happen to Edom pipol; God go distroy dem and di village wey dey round dem. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.”


So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”


human being or animal nor go waka pass der again and for forty years, nor-tin go stay for der.


Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!


bigin shaut wen dem si di smoke from di fire wey dey burn di town kon dey sey, “Who get pawa rish dis big town, Babilon?”


Den di pipol shaut again, “Halleluya! Di smoke from di fire wey burn am go dey go up forever and ever!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ