Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 33:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Di land don dry and nor-tin dey inside again. Lebanon forest don dry finish; Sharon valley bi like desert naw and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 33:9
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem go bi like tree wey dem kwik plok en fruits; like olive tree wey lost en beauti.


Na mi bi di Rose flower from Sharon, di lily flower for di valley.


God go kut dem with axe, just as dem dey kut big trees for forest and dem go fall for groun like Lebanon fine tree!


Cypress trees and cedars for Lebanon dey happy bikos di king don fall, so nobody go kut dem trowey again.


E go distroy all di tall cedar trees for Lebanon, with di oak trees for Bashan


Si, awa Oga God dey ready to skata di world kon turn am to where dem dey trow dirty put. E go shake di world kon skata evribody wey dey stay inside.


But mi God go bring wahala kom di town; dem go mourn and kry and e go bi like my altar where dem for dey do sakrifice.


Den Zion pipol go sidan for groun dey kry and mourn, bikos of dia pipol wey die.


Di desert go sing and shaut bikos e dey happy; e go fine like Lebanon mountins. Di soil go dey good like Sharon and Karmel farms. Evribody go si God glory, en greatness and pawa.


Yu send yor savant kom boast give mi sey yu don defeat di highest mountins for Lebanon with all yor shariot. Yu dey boast sey yu dey kut di cedars tree wey tall pass and di cypress tree wey fine pass for der. Yu still sey yu don rish di place wey far pass for di forest


Dem go woship mi kon lead dia sheep and melu go chop grass for Sharon and for Akor Valley for east.


I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.


So di land go mourn, bikos evritin wey dey inside, go die. All di animals, birds and even fish, go die too.”


Amos sey, “God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois for Jerusalem bi like tonda nois. All di trees and grass wey dey Mount Karmel, dry finish.”


Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.


God kommand di river and e kon dry wons; E make all di river dry rish groun. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees for Lebanon, dry finish.


All di pipol wey dey Lydda and Sharon si wetin happen and dem kon bigin follow Jesus Christ.


For dat time, wi kollect all di towns wey e get. E nor get any town wey wi nor take from dem. Wi take sixty towns and all di aria for Argob wey bi Bashan main kingdom.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ