8 Di main road dey empty, bikos nobody dey travel again. Kontries dey break di agriment wey dem make with each oda and pipol nor dey respet one anoda again.
One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.
Jerusalem road dey mourn, bikos nobody dey pass der go celebrate again. Di town gate kwayet and pain won kill di priests dem. Di yong wimen dey kry, bikos di trobol wey dem dey face, too mush!
David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”