Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 33:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Na-im dey make en pipol strong kon make dem dey save. E dey protet and give dem wisdom and na only doz wey dey fear am, E dey do all dis tins for.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 33:6
39 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God dey with am, so evritin wey e dey do, dey prosper. E fight against Assyria pipol and e nor fear dem.


Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.


My God wey get pawa, di strong One wey save mi, na Yu protet mi wen my enemies dey fight mi.


God dey give en pipol strent and en king dey save, bikos E dey protet am.


Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.


Money na crown for wise pipol head; but foolish pipol work, dey only produce bad result.


Doz wey dey fear God, dey save and God dey guide dia shidren.


To fear God, na wota wey dey give pesin life and e go help yu run from deat.


E betta to get small propaty and still dey fear God, dan to get evritin with many-many wahala.


Obey God and yu go get long life; yu go dey happy and dey save from trobol.


If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God and yu go susid as yu dey learn about God.


Wen pipol dey always sin, dia kountry go get many leaders, but pesin wey get sense and dey undastand tins well, dey bring peace.


With betta judgement, king dey make en kingdom strong, but king wey like money well-well, dey skata en throne.


Wisdom and money fit give yu anytin wey yu wont for life, but na only wisdom fit save yor life.


Pesin wey wise, strong pass ten pipol wey dey rule di town,


So, great Zion, God hill wey dey holy, no evil or wahala go dey der again. Just as wota dey full sea, na so too God word go full pipol heart for di land.


For day time, pipol go sing dis song for Judah land: “Awa town dey strong well-well! God ensef dey defend awa wall and na-im dey make us strong!


and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.


God pipol nor go worry again; peace go dey dia house and dem go dey save.


Instead, una go si Zion, di town where wi for dey celebrate awa festival. Una go si Jerusalem too! E go dey save well-well and pipol go stay der! E go bi like tent wey dem nor dey karry komot from where e dey; tent wey dem nor dey pul en peg from groun and en rope nor go kut.


But God go save Israel and dia viktory go bi forever. Nobody go ever disgrace God pipol again.


Dem go soon free pipol wey dey for prison; dem go get long life and honga nor go kill dem.


So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.


“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”


Just as wota full sea, na so too dem go know about God glory for evriwhere for dis world.


But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own.


wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.


Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.


To live as God wont and dey happy with wetin E give yu, dey bring betta reward.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ