Make Yu nor kill dem just like dat, bikos my pipol go kwik forget di lesin. So, make Yu use yor pawa take make dem dey waka up-and-down without house, den make Yu honbol dem, bikos na Yu my God, dey protet mi.
“So, Jeremaya, make yu tell dem evritin wey I tok. Yu must tell dem sey, ‘Like lion wey won attack, na so too God go shaut from heaven! E go shaut for en pipol from en holy place. E go shaut like pesin wey dey mash grape wey dem won take do wine and evribody for di world go hear am.’
Di nois go loud rish evriwhere for di eart. Bikos God get wetin E one tok against di nashon. E go judge evribody kon kill wiked pipol. Mi, wey bi God, don tok.”