18 Una go remember all di wahala wey una face before, den una go ask unasef, “Where dem rite dis tins put? Where di pesin wey dey hold di money? Where di pesin wey dey kount di towa?”
King Hezekaya for Judah send message go meet Assyria king for Lakish sey, “I know sey I don go against awa agriment. If yu leave us, anytin wey yu sey make wi do, I go do am.” So Assyria king kon ask for three hundred silva and thirty golds from King Hezekaya.
“Make una nor listin to Hezekaya! Bikos Assyria king sey, ‘Make una rite leta kom sey una go respet am and do anytin wey e tok. Den each of una fit chop from di vine and fig kon drink wota from well,
Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?
David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.