Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 33:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Una just dey make yeye plans and evritin wey una dey do, dey yuzles. Di air wey una dey breath, na fire wey go distroy una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 33:11
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”


Wetin make pipol wey dey dis world dey vex? Wetin make dem dey make plans wey go fail?


Pesin wey karry wikedness and bad plans for belle, dey born lie-lie.


E dey dig deep pit for odas, but na en ensef dey fall enter


Just as dem dey distroy grass with fire, na so dem go distroy men wey get pawa bikos of di evil wey dem do and nobody go fit stop di distroshon.


Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.


Instead make wi born pikin, na breeze awa pain born. Wi neva win anytin and wi nor get shidren wey go take-ova awa world.


So, as straw and dry grass dey burn for fire, na so too dia life and all di betta tins wey dem get, go dry and blow trowey, bikos dem don rijet wetin Israel God wey get pawa, tish us.


Una dey go kourt and dey lie for each oda head. Una dey put hope for lie, so dat una go win una kase. Una dey make plans to take hurt oda pipol.


So God nor go let any of di yong men eskape; pity for doz wey dia husband don die or doz wey nor get papa and mama again. Bikos all of dem dey wiked; dem nor know God and evritin wey dem dey tok, bad well-well. But God vexnashon nor go end and E still dey ready to ponish en pipol.


Before una sell di land, nor bi una own propaty? Naw wen una sell am finish, di money nor still bi una own to spend as una like? Wetin make una get dis kind mind? Dis lie wey yu tok so, nor bi pesin yu do am to, but na God!”


Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ