So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
But awa Oga God wey get pawa go kut and skata dem for groun like tree branches. Di ones wey dey proud and dey karry body up, God go ponish dem well-well.
Wen God won kom shake dis eart with en pawa and glory, pipol go hide for hole, inside rock den dig hole for groun so dat dem go eskape from God vexnashon.
Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.
E go bad well-well for una wey dey enjoy life for Zion and una wey feel sey una dey save for Samaria. Una tink sey na una strong pass, bikos Israel pipol dey respet and koll una to kom help dem.
So God sey, “Una must get patient as una dey wait for mi. For di day wen I go attack kon karry all una propaty, I don decide sey, I go gada nashons and kingdoms togeda kon pour my vexnashon on dem. Bikos my vexnashon go full di whole world.