Before-before, God tell dem, “Dis na where una go dey sikure, so doz wey don taya go fit rest for here. Yes! Dis na where una go fit rest put.” But dem nor gri listin to am.
Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: “I wish sey una gri turn from sin kom meet mi kon dey wait with patient, I for diliver una; if una kwayet, dey wait mi, I go give una strent and pawa, but una nor gri wait.
Una go komot from Babilon with joy and dem go lead una komot from di town with peace. Di mountins and hills go dey sing and di trees go dey shaut with happiness.
God sey, “I go make una prosper forever; all di nashon propaty go kom meet una like river wey nor dey dry. Una go bi like pikin wey en mama kare and karry for hand kon trit am with love.
En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
Dem go stay for di land wey I give Jakob wey bi my savant; di land where dia grand-grand papa dey before. Dem with dia shidren and grand-shidren go stay der forever. Na from my savant David house, dia king go always kom from.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
And as wi dey stay inside God, awa love dey grow more-more. So wi nor go fear for judgement day, but wi go face God with konfident, bikos wi live like Jesus Christ wen wi dey di world.