All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.
Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
Una nor dey hear or undastand; na since dem born una, una ear block. Yes, I really know how una wiked and sturbon rish and na wiked pikin dem dey koll una since dem born una.
Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
God sey make I go tell Israel pipol for nort sey, “Una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi. I go sorry for una and I nor go vex again! I nor go vex for una forever.
“Pipol wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi, bikos na mi get una. Among una, I go choose one pesin from each town and two pesin from each family, den bring una kom back to Mount Zion.
so make yu tell di pipol sey, “Dis na wetin God wey dey lead heaven sojas tok: ‘Make una turn kom meet mi and I go kom meet una too, dis na wetin Oga God wey dey rule ova evritin, tok.’
but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.