Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 31:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Egypt pipol nor bi god! Dem bi ordinary human being. Dia horse na just flesh nor bi spirit! God go distroy dem with en hand. Di pipol wey dey help dem, go stagga and di ones wey dem dey help, go fall for groun and all of dem go die togeda.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 31:3
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na only human being pawa dem get, but di Oga wey bi awa God dey with us and E go help us fight all awa war.” So, wetin King Hezekaya tok kon make di sojas get strong heart.


E betta to trust God, dan to trust human being.


So make yu nor feel sey na yor shariot go make yu win, bikos with all en strent, e nor go fit save yu.


Make dem fall with fear. Make Yu let pipol know sey, na ordinary human being dem bi.


Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?


Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.


For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”


Instead, una sey, ‘No! Wi go enter awa horse kon run,’ and true-true, una go run. Una sey, ‘Wi go run with di horse wey fast pass,’ but doz wey dey porshu una, go fast pass una.


God go disgrace Israel pipol, bikos dis pipol nor fit help dem. Dem nor go fit help dem at-all, instead na shame and disgrace dem dey bring.”


Egypt pipol nor go fit help dem at-all and bikos of dis, I koll di land, “Nashon wey dey make mout, but dem nor get pawa.”


Una dey espect Egypt pipol to kom help una, but dat go bi like sey una won use soft stik take waka; but e go break kon wound una hand. Dat na how Egypt king bi to anybody wey put hope on am.” ’ ”


Una sojas nor even dey di same rank with Assyria soja wey small pass, even if una bring Egypt shariot and sojas kom help una.


So God nor go let any of di yong men eskape; pity for doz wey dia husband don die or doz wey nor get papa and mama again. Bikos all of dem dey wiked; dem nor know God and evritin wey dem dey tok, bad well-well. But God vexnashon nor go end and E still dey ready to ponish en pipol.


Una don rijet and turn from mi and na dis make mi vex kon bring wahala for una. I don taya to dey sorry for una.”


God sey, “I go curse di pipol wey leave mi kon go trust human being. Pipol wey depend on flesh and blood for dia pawa.


“Man pikin, go tell Tyre king wetin mi God wey get pawa dey tell am: “Yu dey proud and yu dey sey yu bi god wey sidan for throne and sea dey round yu. Yu fit pritend sey yu bi god, but make yu know sey na human being yu bi and nor bi wetin yu tink.


Wen dem dey kom kill yu, yu go still tok sey yu bi god? By di time yu go si di pipol wey won kill yu, yu go know sey yu nor bi god, but na ordinary human being yu bi.


Men wey dey karry bow nor go fit defend demsef; doz wey dey run fast nor go fit eskape and men wey dey on-top horse nor go fit save demsef.


Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ