Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 30:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Egypt pipol nor go fit help dem at-all and bikos of dis, I koll di land, “Nashon wey dey make mout, but dem nor get pawa.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 30:7
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If God dey vex, nobody go fit stop am. Even juju for wota dey under en leg.


I go kount Egypt and Babilon join di towns wey know mi. I go still kount Filistia and Tyre plus Ethiopia town join dem. All of dem dey sey dem born dem for Jerusalem!


Yu distroy and kill Rahab and Yu skata all yor enemies with yor mighty hand.


Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.


Like tit wey dey pain pesin or leg wey don break, na so too e bi to trust pesin wey nor dey sirious wen trobol kom.


Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?


So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?


For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”


Before-before, God tell dem, “Dis na where una go dey sikure, so doz wey don taya go fit rest for here. Yes! Dis na where una go fit rest put.” But dem nor gri listin to am.


Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: “I wish sey una gri turn from sin kom meet mi kon dey wait with patient, I for diliver una; if una kwayet, dey wait mi, I go give una strent and pawa, but una nor gri wait.


God go disgrace Israel pipol, bikos dis pipol nor fit help dem. Dem nor go fit help dem at-all, instead na shame and disgrace dem dey bring.”


Una sojas nor even dey di same rank with Assyria soja wey small pass, even if una bring Egypt shariot and sojas kom help una.


Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.


Den tell am make e nor worry or fear and make e nor let anybody disturb am, bikos King Rezin, en pipol and Pekah vexnashon nor get pawa rish di smoke wey dey kom out from two firewood.


“Make yu tell Zedekaya wey sey make yu pray make I help dem sey, ‘Egypt sojas wey bin dey kom help yu, go-go back to dia town wen dem don help yu finish.’


So e betta make wi sidan kwayet kon wait until God go kom save us.


Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ