Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?
Instead, una sey, ‘No! Wi go enter awa horse kon run,’ and true-true, una go run. Una sey, ‘Wi go run with di horse wey fast pass,’ but doz wey dey porshu una, go fast pass una.
Una dey espect Egypt pipol to kom help una, but dat go bi like sey una won use soft stik take waka; but e go break kon wound una hand. Dat na how Egypt king bi to anybody wey put hope on am.” ’ ”