Assyria king find out sey King Hoshea dey plan against am, bikos e don send message go meet King So for Egypt and e nor gri pay tax to Assyria king again. So Assyria king kon arrest and put am for prison.
Zoan leaders na fools! Wise men for Egypt dey give di king yeye advise, if not, wetin go make yu tell Fero sey, “I dey among doz wey sabi rite and wi dey plan to ova-trow yu?”
Una dey put perfume and oil for body go woship Molek wey una dey koll god. Bikos una dey find gods to woship, una dey send messenjas go far, even go rish where dead body dey.
So I kon go meet and tell Edom pipol sey, “I don receive message from God. E don send messenja go tell all di nashons sey make dem gada dia sojas and make dem ready kon attack una.
Darkness go kover Tahpanhes town wen I break and end di pawa wey Egypt get, wey make dem dey make mout and karry body up. Kloud go kover Egypt and all di pipol wey dey inside. Den sojas go katch and karry all of dem go prison.
Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”
Dis na di vishon wey God give Obadaya about Edom pipol. God send en savant kom di nashons and dem hear di message wey God give dem sey: “Make una ready! Make una gada una sojas go fight Edom pipol!”
Wen dem pass thru Negev, dem kon rish Hebron for Ahiman, Sheshai and Talmai, where Anak shidren-shidren dey stay. (Naw, dem don build Hebron seven years before dem build Zoan for Egypt.)