But God sey, “Axe go fit sey e big pass di man wey dey use am? Abi cutlass dey important pass pesin wey dey use am kut sometin? Nor bi gun dey karry pesin wey hold am, but na di pesin dey karry am.”
Mi, God wey get pawa, go use my kane take flog dem, just as I flog Midian pipol for Oreb Rock. I go ponish Assyria pipol, just as I take ponish Egypt pipol before.
I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.
“Dem go kill Assyria pipol with swod for war and nor bi swod wey human being make. Assyria pipol go run from di swod and dem go turn dia yong men to slaves.
All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.