Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 30:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 For dat time wen dem kill pipol well-well and di towas don fall, wota go dey flow kom from evry mountin and hill.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 30:25
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos dem don run leave dia strong town. Di town wey pipol bin full don turn empty place. Nobody dey stay dia hill and towas again and naw, na der wiked donkey and sheep dey for chop grass.


So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!


Wota nor hongry dem wen E take dem pass di desert; E tear rock open, Yes! E make wota flow kom out from di rock.


Dis na wetin God dey tok: “I go kut di branches wey high pass for di cedar tree komot, den I go plant am on-top mountin


I go remove dem from strenja land; gada dem togeda kon bring dem back to dia own kountry. I go lead dem go back to di mountin and Israel river wey dey flow kon give dem betta food chop.


I go bless dem kon let dem stay near my holy hill and for der, I go bless dem with betta rain anytime wey dem wont am.


Den di man bring mi kom di temple front and I si wota dey kom out from under di gate dey rush go east; di place wey di temple face. E dey flow well for di sout-side for di temple near di altar.


For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins and di hill go flow with milk. Wota go dey evriwhere Judah, but river go from God temple rush go wet Shittim Valley.


All wetin dey guide yu, go fall. Dem go skata dem fall like fig fruit wey don ripe: wons dem shake di tree, di fruit go fall enter dia mout.


Dem go get enough rain and dia shidren-shidren go plenty like river; dia kings go get pawa pass Agag and pipol go praiz dia kingdom.


Di pesin wey bilive mi and wetin I tok, make e kom drink, just as God word sey, ‘Plenty wota wey dey give life, go flow from inside en belle.’ ”


Di tins wey wi take dey fight, nor bi dis world own, but na God make am strong, so dat wi go fit skata all di strong place where wiked pipol dey. Wi dey skata trobol;


Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ