Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 30:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Una go distroy una juju wey dem make with silva and gold. Una go trowey dem like rag wey dem take klean groun kon sey, “Make una take dem komot here.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 30:22
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta di feast, Israel pipol for Judah kon go skata di pilas, Asherah juju pole, all di high place and altar where dem for dey serve juju for Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes. Den all of dem kon go back to dia house.


So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.


Bikos I know sey di time go kom wen all of una go trowey di juju wey una use gold and silva take make.


E nor bi like juju wey man make or di one wey doz wey dey karve wood kover with gold or put silva.


Pipol dey pour gold from dia bag kon measure dia silva. Dem go hire pesin wey go use di gold make juju for dem and den, kon woship am.


Jerusalem dey beg for help, but nobody gri help am. God don tok against Jakob sey, “Doz nashons wey dey around yu, go bi yor enemies! Dem go ponish and trowey Jerusalem like dirty rag!”


“Naw, make yu tell Israel pipol wetin mi God wey get pawa dey tok: Make una turn back from una juju and from di yeye life wey una dey live.


nor dey serve Israel pipol juju or chop food wey dem sakrifice give juju:


Wen una remember di wiked and wrong tins wey una do before, una go hate unasef, bikos of una sins.


Dem go trowey dia gold and silva for di street like sey na dirty, bikos gold or silva nor go fit save dem wen God vexnashon go kom and dem nor go fit use am get wetin dem wont or chop am like food and na dis gold and silva make dem sin.


Before-before, dem dey make yanga with dia fine-fine tins kon take di tins do juju. So na bikos of dis, God make dia money and propaty dey yuzles.


Efraim pipol nor go get anytin to do with juju again. I go ansa dia prayers kon kare for dem. I go give dem house like betta green fig tree and na mi go bless dem.”


Di priest go burn am with fire, bikos of di diziz wey spread for di klot.


For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again.


Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”


Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ