20 Aldo, God go give una sofa chop like food kon make una drink pain una; but E go still dey with una to tisha una. Una go si una tisha with una own eye.
Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”
Make una chop am with bread wey dem nor make with yist and una go chop dis bread for seven days, just as e bi wen una rush dey komot from Egypt. Make una chop dis bread (bikos na-im una chop wen una dey sofa), so dat as long as una dey alive, una go remember di day wey una komot from Egypt.