Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 30:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 So na dis sin go distroy una. Una go bi like high old wall wey don krack and wey go soon fall and na wons e go fall.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 30:13
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.


Make yu dey kareful, so dat dem nor go fool yu with money or sey yu follow money go di wrong way.


How long una go dey treaten one man? All of una dey kill pipol and una bi like wall wey don break or fence wey get mark wey go soon fall.


Dem dey spend all dia time dey plan how dem go take finish mi. Dem dey happy to lie about mi. Dem dey praiz mi for my present, but for dia heart, dem dey curse mi.


If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.


Bikos of dis, dem nor go know before wahala go kom meet and distroy dem finish.


But dis na wetin Oga God wey dey lead heaven sojas tell mi, “True-true, as long as dem dey alive, I nor go forgive dem dia sin.” Mi wey bi God wey get pawa, don tok.


bikos God dey kom from where E dey stay for heaven kon ponish pipol bikos of dia sins. Di eart go show all di innocent pipol blood wey dem share on-top am and e nor go ever forget di innocent pipol wey dem kill.


Jerusalem, all di strenjas wey attack yu and di sojas wey make yu dey fear, na wons God go blow dem komot like ordinary dust.


Full moon lite go shine like sun for aftanoon and sun lite go shine seven times pass as e dey shine before and e go bi like seven days lite. Den God go join en pipol bones wey bin break kon heal all dia wound.


So, wahala go kom meet yu and yor majik nor go fit help yu. Wahala wey yu nor espect, go happen to yu at wons! Even trobol wey yu nor tink of, go rush kom meet yu like wota.


God sey, “I dey tok about di tins wey go happen before e happen. Den na wons I do dem and dem kon happen.


Una pipol go build wetin don skata since, dem go build am put for di old foundashon again. Dem go know una as pipol wey ribuild di wall and house wey dem bin skata.”


for dia sins and dia grand-grand papa own. Dem don burn incense for juju hills kon tok bad tins about mi. So I go ponish dem for wetin dem don do pass.”


Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, na wons e go fall skata for groun.”


But di pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like man wey build house wey nor get strong foundashon. Wen big wota kom, di house go fall skata.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ