11 “Nor do good again, but make yu kom join us. Make yu nor tell us about di Holy One for Israel again.”
Na who yu dey trobol and curse like dis? Na who yu dey shaut for and look with bad eye? Na di Holy One for Israel?
Dem dey tell God sey ‘Leave us! Wi nor won serve or follow Yu.’
God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
God go distroy doz wey dey lie against dia neighbours; pipol wey dey katch and kill pipol and doz wey nor dey give korrect judgement.
Nor profesai for Bethel again, bikos na here di king for dey woship for di main temple.”
If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!
But “Elymas” wey bi magician, (bikos na wetin en name mean bi dat) kon dey oppoz dem, so dat di Roman offisa nor go bilive wetin dem dey prish.
Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.
to tok bad about odas and hate God. Dem dey karry body up, dem nor get respet and na bad tins full dia mind. Dem nor dey respet dia papa and mama.
Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.
Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand.