Wiked men dey opress my pipol and doz wey borrow dem money, don turn to dia oga. My pipol, una leaders dey lead una anyhow and naw, una nor know di rite road wey una suppose follow.
God sey, “Si how Jerusalem wimen dey karry body up! Dem dey waka dey karry dia head up and roll dia eyes. Dem dey waka small-small make dia shain for dey make nois.