Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 3:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Instead make dem dey scent well, dem go dey smell. Instead make dem wear betta belt, dem go tie rope for waist. Instead make dia hair fine, hair nor go dey dia head at-all. Na rag dem go dey wear, instead of fine klot. Dia beauti go turn to shame!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 3:24
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem trit di girls well for one year, dem massage dem with myrrh oil for six monts and balsam oil for di oda six monts. Afta, dem kon dey take each girl go meet di king.


I dey mourn with sak klot and I use san take kover my face.


E dey make klot and belt kon sell dem give tradas.


I don put myrrh, aloe and cinnamon perfume for di bed.


Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.


Na sak evribody go wear dey waka; dem go dey mourn and kry for dia house and for evriwhere for di town.


For dat time, Oga God wey dey lead heaven sojas kon sey make una dey kry, mourn, shave una hair and wear sak klot.


dia garments wey dey show dia body; dia handkachief, dia head-tie and di long klot wey dem dey wear for dia head.


God go use en pawa take judge and make di nashons holy. E go forgive Jerusalem pipol dia sins kon klean di land bikos of pipol wey dem kill for der.


Una dey put perfume and oil for body go woship Molek wey una dey koll god. Bikos una dey find gods to woship, una dey send messenjas go far, even go rish where dead body dey.


So make una wear sak klot, kry and roll for groun, bikos God still dey vex well-well for Judah.


All of dem don shave dia hair and barber dia bear-bear. Dem wear sak kon kut dia hand, so dat di marks go show sey dem dey mourn.


Heshbon pipol, make una kry, bikos dem don distroy Ai! Rabbah wimen, make una wear sak klot kon mourn. Make una dey konfuse, bikos dem go karry una god, Molek with en priests and princess, go anoda kountry.


I still sey, “My pipol! Make una wear sak klot and roll for groun. Make una kry well-well and mourn like sey una only pikin just die. Bikos very soon, doz wiked sojas go kom distroy all of us.”


Jerusalem leaders sidan kwayet for groun. Dem wear sak klot kon pak dust put for dia head and di yong wimen kover dia face for groun with shame.


Dem go skrape dia hair for una kon wear sak klot. Dia heart go bitter as dem dey kry.


Dem go wear sak as klot for body and dem go dey fall as dem dey waka. Dem go skrape dia head and na shame go follow dem.


Make una kry like virgin wey dey mourn for di man wey e suppose marry.


I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant.


“I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.


Judah pipol, make una mourn and shave una hair, bikos dem go karry di shidren wey una love go as slave. Make una skrape una head like vulture own, bikos dem go karry una small-small shidren go work as slave for anoda land.


God go kill una with bad diziz, fever, sore, kro-kro and kold. Dis diziz go attack una until una die finish.


Honga go kill dem, betta sofa go worry dem. I go send wiked animal and bad snakes go chop dem.


Make una beauti nor bi di one wey pipol dey only si like: to dey plait hair; dey wear gold or fine klot.


I go give my two witness authority to profesai for 1,260 days and na sak klot dem go wear.


den di heat kon dey burn pipol, yet dem still dey curse God wey get pawa to stop dis sofa and dem nor gri turn from sin kom meet God or gi-am all di glory.


Den di kings for dis world wey follow am kommit sin and enjoy yeye life, go kry kon shaut for am wen dem si di smoke from di fire wey dey burn am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ