Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 3:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Why una dey wahala my pipol and sofa doz wey nor get money? Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 3:15
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oga God, dem dey kill yor pipol and wound doz wey Yu koll yor own.


Fero pipol kon bigin beat Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol, den dem ask dem, “Why una nor komplete una work yestiday and today, just as una dey do before?”


“Dia tit bi like swod and dia mout sharp like knife. Dem dey distroy poor pipol komot from dis eart and pipol wey nor get food to chop, dem dey kill dem trowey.


Una dey opress poor pipol and nor gri give dem dia freedom. Una dey do like dis, so dat una go fit tif from shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die.


Na God dey guide and save poor pipol. But E go make honga kill Filistia pipol finish.


Pipol wey dem dey opress before, dey mash dem pass naw. Yes, poor pipol dey waka on-top dem naw.


Poor pipol and doz wey honbol diasef go si di happiness wey di Oga wey bi Israel pipol God, dey give.


Bikos of dis, di Oga wey bi God for Israel sey, “Una don rijet dis message kon bilive una pawa wey bi to opress and deceive pipol. Yes! Una really love una bad karata.


Foolish pipol dey tok anyhow and na wikedness full dia mind. Tins wey God nor like, na-im dem dey like to do and dem dey tok yuzles tins about di Oga awa God. Pipol wey dey hongry, dem dey make hongry kill dem more and doz wey nid wota, dem nor dey gri give dem wota drink.


Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.


Una fasting dey make una wiked and una still dey kworel and fight. Una tink sey dis kind fasting go make mi listin to una prayers?


God sey, “Dem bi my pipol and dem nor go lie give mi.” E save dem


“Israel pipol, dis word wey una dey always tok for dis land, na wetin e mean? Una dey sey, “ ‘Mama and papa dey chop grape wey don sawa, but na di shidren dey feel di sawa taste for dia mout.’ ”


Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ