So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?
God sey, “Si how Jerusalem wimen dey karry body up! Dem dey waka dey karry dia head up and roll dia eyes. Dem dey waka small-small make dia shain for dey make nois.
Di offisa kon ansa, “Una tink sey na only di king and una three, di king send mi kom tell all dis tins? No! I still dey tell di pipol wey sidan for di wall, wey go soon chop dia shit kon drink dia piss, just as unasef go do.”
di Oga wey bi una God dey defend una naw sey, “I dey take di cup wey I give una with vexnashon. Una nor go drink di wine wey dey make una stagga again.
Dem attack dia neighbour from rite, but dem still dey hongry. Dem chop dia neighbour from left, but dem nor beleful. Dem even dey chop dia own shidren join.
So, King Zedekaya kon sey make dem lock mi for di kourtyard wey dey di palis. I stay for der and evriday, dem dey give mi bread chop, until all di bread for di town finish.
Una nor go get food to chop and ten wimen go dey bake all dia bread wey dem get for only one oven. Dem go share am and afta una don chop finish, una go still dey hongry.
But naw, wetin make una dey shaut and kry? Una nor get king to lead una? Abi dem don kill una wise men finish? So wetin make una dey feel pain like woman wey won born?