Si! One messenja dey from di mountin kom give una good news! E dey bring peace message kom. So my pipol for Judah, make una celebrate kon do wetin una promise, bikos una wiked enemies nor go ever enter una land again and God go distroy dem finish.
Nineveh pipol, somebody dey kom attack and skata una land. So, make una guide una town well-well and wosh una road too! Make una dey strong and ready to fight!