Even di profets and di priests dey stagga bikos dem don drink well-well. Dem don drink plenty wine and e dey konfuse dem. Dem don drink sotey dem nor dey fit undastand di vishon wey God send kom or judge any kase well.
Nashons and kings go kare for una as mama dey kare for en pikin. Den, una go know sey, mi wey bi God, don save una. Israel God wey get pawa don free una.
“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”
“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.