God sey, “I go bring wahala kom di eart and I go ponish all di wiked pipol, bikos of dia sin. I go make anybody wey dey proud, honbol and I go ponish evribody wey dey sturbon and wiked.
But dis na wetin God tok: “True-true, dem go release doz wey dey prison and dem go seize wetin strong men karry kom from war. I go fight with anybody wey fight with una kon save una shidren.
Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.
“As I still dey look for di vishon, di nomba four beast kom out: E get pawa, e wall-wall and pipol dey fear am well-well. En tit dem na iron. E dey distroy and skata anytin kon use en leg take skata wetin remain. E dey difren from all di beast wey first kom and e get ten horn.
E go bad for doz wey nor dey sleep for nite, bikos of di bad tins wey dem dey tink and plan to do. For early morning, dem go rush go do wetin dem plan, bikos dem get pawa to do am.
But dis na wetin God dey tok, “I dey plan to distroy dis pipol and dem nor go fit eskape am. Trobol go follow dem, den dem nor go dey waka with pride again, bikos dat time go bad for dem.”
Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate.
Den I hear one loud vois for heaven dey sey, “Salvashon; pawa; authority wey Christ get and God kingdom, don kom at last. Bikos di pesin wey dey akuiz awa brodas and sistas evriday, God don trow am kom down.