Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 29:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 29:15
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen e mourn finish, David kon bring am kom di palis and e born boy for am. But God nor like wetin David do.


Israel pipol do some bad tins and di Oga dia God nor like am. Dem build juju house for all dia towns; from di towa wey di men from dey wosh go rish di town wey dem guide well-well.


E nor get as di darkness tick rish, e nor fit hide sinnas from God.


Make Yu listin to how dem dey curse mi and even for publik, dem dey treaten to kill mi dey sey, “Afta wi don finish with yu, nobody go shalenge us!”


Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?”


Dem dey plan against yor pipol and dem won wound di ones wey Yu love.


Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.


Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.


God sey, “I go ponish my shidren wey nor dey obey my kommand. Pipol wey dey do wetin dem like and enter agriment with wiked pipol kon dey do tins without my Spirit. Dem just dey add join dia sins.


Yu trust yor wikedness kon sey, ‘Nobody dey si mi.’ Yor wisdom and di sense wey yu get dey deceive yu wen yu sey, ‘I dey special and nobody bi like mi.’


Una tink sey wetin una dey do dey rite, but I go disgrace una and una juju nor go fit help una.


E nor get where pesin go hide put make I for nor si am. Yu nor know sey I dey evriwhere for di heavens and di eart?


God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”


Den E sey, “Man pikin, break di wall.” I break am and I kon si one door.


God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.


Una don dig one deep pit for where una dey woship juju, so I go ponish all of una.


I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.


Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”


Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ