and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.
God wey save una, di Pesin wey dey holy for Israel, dis na wetin E tok: ‘Na mi bi di Oga una God, di Pesin wey dey tish una wetin dey good. Di One wey dey show una di road wey una go follow.
God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
So I ansa, “If I go warn and tok to dem, na who go gri listin? Dia ear block, so dem nor go hear mi, bikos God word dey make dem vex well-well and dem nor like am at-all.
For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.
Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.