6 E go give wisdom to doz wey dey judge, so dat dem go judge well. E go give strong heart to doz wey dey defend di town, so dat dem nor go fear any attack.
Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.
Na only human being pawa dem get, but di Oga wey bi awa God dey with us and E go help us fight all awa war.” So, wetin King Hezekaya tok kon make di sojas get strong heart.
bikos na Yu dey protet poor pipol and doz wey nor get anytin. Yu dey protet dem from rain kon kover dem from hot sun, bikos di way wiked pipol dey bihave, bi like heavy rain wey dey fall.
I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.
I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”