Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 28:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Di leaders wey drink dey katch, dem go mash dia crown for groun.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 28:3
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Jehu orda, “Make una trow dat woman kom down!” So dem trow Jezebel from di window kom down. And as Jezebel nak groun, en blood kon spread go di wall and di horse body, den Jehu ride en horse pass Jezebel dead body.


God go protet and guide Mount Zion, just as pipol dey mash grass pass, na so too E go take distroy Moab pipol.


Pipol wey dem dey opress before, dey mash dem pass naw. Yes, poor pipol dey waka on-top dem naw.


Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.


Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.


Una own don finish! Una wey dey wake up for early morning bigin drink. Una dey drink still evening until di drink katch una well-well.


God ansa, “I mash di nashons like grapes by mysef. I use my vexnashon mash dem and na dia blood stain my klot so.


Israel and Samaria pipol wey get pride and sturbones go know kon sey,


God don turn all my strong sojas to fool. As E kommand, many sojas kom distroy my sojas. God mash and press my pipol, just as dem dey press grape.


Den I hear one angel dey ask anoda one sey, “How long dis tin wey dey happen for dis vishon go kontinue? Dis wiked tin wey dem dey do go replace di sakrifice wey dem dey do evriday? How long di sojas wey dey heaven and di temple go dey under en leg?”


If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish?


But nor measure di temple varanda, bikos God don gi-am to Gentile pipol and dem go mash am for forty-two monts.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ