Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 28:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 All dis wisdom dey kom from God wey dey lead heaven sojas. Na-im dey give pipol wisdom and dey guide us for evritin wey wi dey do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 28:29
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.


Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.


Dis na God handwork and e dey wonderful for awa eye.


My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.


Wi dey si di great work wey Yu do! Di tins wey Yu dey tink, deep well-well.


Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do and na only fools nor go undastand sey:


Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.


E must grind en flour if e won make bread. En melu wey e take dey work, e know how e go take karry dem pass di farm, so dat dia leg nor go distroy di rice.


God wise well-well! E dey do just as E tok. E go ponish wiked pipol and doz wey dey enkourage pipol to sin.


Pipol go si dis tins and dem go know sey, na mi wey bi God, do am. Den dem go undastand sey, na Israel God wey dey holy, make all dis tins happen.”


Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”


Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.


Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ