26 E know how to do en work, bikos God don tish am how to work as farmer.
But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter and give human being wisdom.
Dem nor dey turn to God wey make us get sense; di One wey make us wise pass animals and birds.
Na mi make am nor get sense like dat! Na mi nor gi-am wisdom.
I go praiz God wey bi my rock, bikos na-im dey protet mi. Na-im train my hand for war kon give mi pawa to fight.
If E fit ponish wiked nashons, una tink sey E nor go ponish una? E know evritin, so make una nor tink sey E nor know wetin una dey do.
Tell all di pipol wey know how to do dia handwork well-well and wey I don fill with di spirit wey dey give wisdom sey, make dem make Aaron garment wey go make am difren from oda pipol as e dey serve as my priest.
Den Moses tell Bezalel, Oholiab and evribody wey get handwork wey God don give wisdom and wey get mind to work sey, “Make una bigin work.”
Wons e just prepare di soil, e go plant di seed and herb put kon plant wheat, barley and rice for di korna.
E nor dey use heavy hoe take dig di seed kom out, instead, e dey use small-small stik wey bi dia size.
Dem dey sey, “Who God dey try to tish sef? Who E dey esplain en message for? En message good for only shidren wey just stop to suck breast!
God kon give dis four men good sense; difren gift and wisdom. God give Daniel di gift to take tell pipol wetin vishon and dreams, mean.
bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.