bikos na Yu dey protet poor pipol and doz wey nor get anytin. Yu dey protet dem from rain kon kover dem from hot sun, bikos di way wiked pipol dey bihave, bi like heavy rain wey dey fall.
“Jerusalem pipol! Jerusalem pipol! Una wey kill profets and stone pipol wey God send kom meet una! E don tey wey I won gada una shidren as fawol dey gada en pikin under en feada, but una nor gri!
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.
Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”