7 Na for dis mountin God go for swallow sorrow, pain and evry bad tin wey dey trobol en pipol.
Many pipol and strong nashons go kom Jerusalem kon woship and pray to God wey get pawa, so dat E go bless dem.”
At wons, di temple kotton tear from up go rish bottom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwhere.
Na-im bi di lite wey go show Gentile pipol road kon bring honor to yor pipol, Israel.”
God don forgive us for di time wen wi nor know wetin wi dey do, but naw, E dey kommand pipol for evriwhere sey make dem turn from sin kom meet am,
Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand.
Before-before, una dey for darkness, but naw, una bi lite wey dey shine inside Christ. So make una dey do tins like shidren wey get lite,
Christ nor enter di Holy Place wey human being build like di original building for heaven, but na heaven e enter and naw, e stand for God present for awa sake.
Di Holy Spirit kon esplain sey, “Di way to rish di Holy Place neva open as long as di old tent still dey.”