Nobody get joy or dey happy and inside di vineyard; nobody dey dance or shaut; no grape even dey to press to make wine, bikos I don end dia shaut for joy.
bikos dem don distroy di farm wey dey near Heshbon kon skata di vineyard for Sibmah. Yes! Di rulers for di nashons skata di vines go rish Jazer kon enter di desert, den cross di sea.
For Judah town and Jerusalem street, I go make sure sey nobody dey shaut or happy with joy sey pesin dey marry. Dis na bikos di whole land dey empty and dirty don full der.”
Yes, I go vex distroy dia land. I go make dia land empty and from sout, e go bi like desert go rish Diblah town for nort. Yes! E go bi like dat for evriwhere wey dem dey stay. Dat time, dem go know sey na mi bi God.’ ”