Wetin una go gain if una go back to Egypt go beg dem to kom help una? Wetin una tink sey una go gain, if una go Assyria go beg to drink wota from Eufrates River?
Bikos di land wey una go soon enter go stay, nor bi like Egypt where una from dey kom and where una nid to work with una hand and leg to take plant vegitabol.
from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land