God sey, “Una wey dey for far land, make una listin to mi! Make una kom meet mi make I give una new pawa! Make una kom tok to mi; make wi kom togeda kon setol di matter.
“Man pikin, go tell Tyre king wetin mi God wey get pawa dey tell am: “Yu dey proud and yu dey sey yu bi god wey sidan for throne and sea dey round yu. Yu fit pritend sey yu bi god, but make yu know sey na human being yu bi and nor bi wetin yu tink.