Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 23:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Wen di seventy years don pass, God go make Tyre strong again. Di town go kon rish and go dey sell tins give all di oda kingdoms.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 23:17
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time, dem go forget Tyre for seventy years, wey bi di normal years wey king suppose stay for dis world. Wen dat time don pass, pipol go know Tyre again and e go bi like di ashawo wey dey dis song:


“Make una take di harp kon go round di town, una wey bi ashawo wey dem don forget! Make una play and sing una song, so dat men go kom meet una again.”


Dis land go empty, So Israel pipol and doz wey dey stay near dem, go serve Babilon king for seventy years.’


“God sey, ‘Wen di seventy years wey I give Babilon don finish, I go kare and bring una kom back to una land, just as I promise.


Yu trowey yor beauti for portor-portor, bikos anybody wey kom meet yu, yu dey sleep with am and yor ashawo dey strong evriday.


Yor ashawo friends wey kom from Egypt, yu let dem sleep with yu and naw, yor ashawo life dey make mi vex.


For evry street, yu build where pipol go for dey woship juju and learn ashawo. But yu still betta pass ordinary ashawo, bikos yu get money.


“Si, I dey klap my hand as una dey tif and kill.


I go skata all di image kon burn all dia juju propaty, bikos dem buy dem with ashawo money kon use dem pay ashawo for anoda place.”


Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”


All dis tins dey happen, bikos Nineveh pipol too do ashawo, dem don sharm odas nashons and make dem dia slave.


Doz wey remain for Judah go stay for der. Dem go stay and dey chop for di house wey Ashkelon pipol run leave. Oga God go visit en pipol with kindness and make dem prosper again.


Pita don tell us how God first choose some pipol from Gentile wey go dey tok about am.


Wen una dey bring una vow ofrin, make una nor bring any ashawo pesin ofrin kon give di Oga una God, weda na man or woman, bikos dat kind tin dey make di Oga una God vex.


Make e nor bi drunkard or pesin wey like to fight; but e must dey gentol. Make e nor bi pesin wey like to kworel or love money.


Like dis too, deakons must bi pipol wey get good karata; nor bi pipol wey dey play wayo; dey drink anyhow or love money.


Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.


bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ