Dem karry Judah pipol go Babilon as slave kon dey sofa dem. Na anoda land dem dey stay and dem nor get peace at-all. Even with di pain wey dem dey pass thru, evribody wey porshu dem, katch and ponish dem.
Naw, pipol dey shaut for dem anyhow sey, “Komot for here! Una wey dey smell! Make una nor tosh us!” So dem kon komot der go anoda town, but any town wey dem waka go, di pipol dey porshu dem.
Kittim pipol go kom with ship kon fight am and fear go katch am. E go turn won kon distroy God pipol. Den e go-go back kon favor doz wey rijet di holy kovenant.
So, di pipol wey dey play harp, sing music, blow flute and trumpet, dem nor go ever hear dia sound from yu again. Doz wey get handwork and business pipol, dem nor go ever si dem inside yu again. Pipol wey dey grind tins, dem nor go ever hear dia nois inside yu again.