Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”
I go skata Damaskus town gate; I go remove di ruler from Aven Valley kon kill di pesin wey whole di royal rod for Bet-Eden. Dem go katch Aram pipol kon karry dem go Kir land as prisona.” Dis na wetin God tok.
God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.