Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
Bikos dem don run leave dia strong town. Di town wey pipol bin full don turn empty place. Nobody dey stay dia hill and towas again and naw, na der wiked donkey and sheep dey for chop grass.
So dis na wetin God tok about Assyria king: ‘E nor go enter dis town or shot one arrow against am. No soja wey karry shield go kom near di town and dem nor go build anytin take surround am.
Anytime I dey strol outside di town, doz wey dem kill for war, na dia dead body I dey si for road and wen I enter di town, I go still si sey pipol dey die, bikos dem nor si food chop. Profet and priest dey do dia work, but dem nor know wetin dem dey do.”
“God sey, ‘Anybody wey stay for di town go die for war or honga or diziz go kill-am. But di pipol wey go-go surenda give Babilon pipol, nor go die; dem go eskape with dia life.’ ”
Jerusalem, where many pipol dey stay before, don empty naw. Di town wey great pass oda nashons before, don bi like woman wey en husband die leave. Na Jerusalem bi kween for di world before, but naw, na slave e bi.
Si, Oga God! Why Yu dey ponish us like dis? Make wimen chop dia shidren wey dem love? Or make dem kill priests and profets for inside God temple, bikos of sofa?
Dis na di find town wey dem guide well-well before. Di town bin dey boast sey, “Na mi great pass! E nor get any town wey bi like mi!” But naw, si as e don turn where dem dey trowey dirty put and na wild animals dey stay der naw. Evribody wey dey pass der, dey laf and shake dia head bikos of am.