As Haman still knee down near Estha dey beg am, di king kon waka enter from di gardin. As di king si am, e kon sey, “So yu even won rape my wife, di kween for my present?” As di king still dey tok, dem kon kover Haman face.
‘Who give yu di rite to stay here? Wish of yor family memba dem beri for here? Who give yu rite to won dig grave for yorsef for here? Yu dey karve grave for yorsef inside di rock.
E go pick yu like ball kon trow yu go anoda land wey far well-well. Yu go die for der near di shariot wey dey make yu karry body anyhow. Yu bi disgrace for yor oga house.
Rish pipol send dia savant go fetch wota for well, but dem nor si wota fetch, so dem kom back with dia empty kontaina. Dem kover dia face, bikos dem dey shame and dey konfuse.