Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 22:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 God wey get pawa wey dey lead heaven sojas, dis na wetin E tok, “Go meet Shebna wey dey manage di royal house kon tell am,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 22:15
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Ahishar dey kare for di palis savants, while Adoniram wey Abda born, dey kare for doz wey dey do hard work.


So di pesin wey dey look di palis, di leader for di town, di eldas and di guards kon send dis message go meet Jehu sey, “Wi bi yor savants! Wi go do anytin wey yu tok. Wi nor go fit crown anybody. Make yu just do wetin yu know sey dey good.”


Dem sey make dem go koll di king kom, so Hilkaya pikin, Eliakim wey dey guide di palis, with Shebna wey dey rite wetin dey happen for di palis and Joah pikin Asaf wey bi di palis seketry kon go meet dem.


Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Joah kon ansa di adviser sey, “Make yu use Aramaik language take tok to yor savant, bikos wi undastand am. Nor tok to us with Hibru bikos of di pipol.”


Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Asaf pikin Joah kon tear dia klot go meet and tell Hezekaya wetin di shief adviser tok.


E send Eliakim, Shebna and di priest oga with di sak klot wey dem wear sey make dem go meet Profet Isaya, Amos pikin, sey:


Dis na di pipol wey keep di king propaty for en palis: For di royal store room, Azmavet wey Adiel born, dey der. Na Jonatan wey Uzzaya born, dey di local store room. To dey do farm work na:


Den Eliakim, Shebna and Joah tell di offisa, “Make yu speak Aramaik give us. Wi dey undastand am, make yu nor speak Hibru, bikos all di pipol wey dey di wall dey listin.”


Den Eliakim, Shebna and Joah vex tear dia klot kon go tell di king wetin Assyria offisa tok.


Den, Eliakim wey Hilkaya born, Shebna wey bi di kourt seketry and Joah wey bi Asaf pikin wey dey keep rekord, kom out kon go meet Assyria offisa wey di king send kom.


E send Eliakim wey bi di offisa wey dey kare for di palis, Shebna wey bi di kourt seketry and di senior priest go meet Profet Isaya wey bi Amos pikin and all of dem wear sak klot too.


So Filip kon dey waka dey go where di angel tell am. As e dey go, e meet one uncle wey kom from Ethiopia, e bi offisa for Kandace wey bi Ethiopia kween and na-im dey keep dia money. E kon woship God for Jerusalem


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ